Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 14:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 Dem plan against am for Jerusalem, so e run go Lakish. But dem send some men go find and kill-am for der.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 14:19
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di rest tins wey Amazaya do, dem rite am for Judah kings history book.


Dem karry en dead body put for horse kon beri am for Jerusalem with en grand-grand papa dem for David Town.


Jabesh pikin, Shallum kon plan and kill-am for Ibleam, den take-ova as king.


Gadi pikin, Menahem kon from Tirzah go attack King Shallum for Samaria. E kill-am kon take-ova as king.


En offisa Pekah wey bi Remalaya pikin plan against am. En and fifty men from Gilead kon kill King Pekahaya, Argob and Arieh for Samaria. Dem kill dem for di place wey dem dey guide pass for di palis. Pekah kon take-ova as king.


For twenty years wey Uzzaya pikin, Jotam don dey rule for Judah, Elah pikin, Hoshea kon plan and kill King Pekah wey Remalaya born, den e take-ova as king.


King Hezekaya for Judah send message go meet Assyria king for Lakish sey, “I know sey I don go against awa agriment. If yu leave us, anytin wey yu sey make wi do, I go do am.” So Assyria king kon ask for three hundred silva and thirty golds from King Hezekaya.


Assyria king send en sojas oga, di kourt oga and di adviser with many sojas from Lakish go meet King Hezekaya for Jerusalem. Wen dem rish der, dem kon go stand near di wota wey dey for di road wey dem dey pass go di field where dem for dey wosh and dry klot.


Amon savants kon plan and kill-am for en palis.


Wen King Ahazaya for Judah si wetin happen, e kon run face Bet-Haggan. Jehu porshu am kon sey, “Make una kill-am too.” Dem shot am as e dey drive dey go Gur near Ibleam. But e still manage run until e rish Megiddo for where e for die.


and dat time, Babilon king and en sojas dey attack di town. Di sojas still attack Lakish and Azeka, di only oda strong town wey remain for Judah.


Lakish pipol, make una karry una horse and propaty run. Na una bi di first town for Judah wey join Israel pipol sin and una kon make Jerusalem pipol, sin too.


So king Adoni-Zedek for Jerusalem kon send message go meet King Hoham for Hebron, King Piram for Jarmut, King Jafia for Lakish and King Debir for Eglon:


Joshua and en sojas kon mash from Libnah go Lakish. En and en sojas kon fight against Lakish


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ