Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 14:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Yu distroy Edom pipol and e don dey make yor head big! Yu dey happy bikos yu win, but make yu stay for yor palis. Wetin make yu dey kause wahala for yorsef? Wetin make yu won distroy yorsef and Judah?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 14:10
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E win 10,000 Edom sojas for Salt Valley, katch Sela for war kon gi-am anoda name wey bi “Jokteel” and na dis name dem dey koll am kon rish today.


E kon use en pawa take distroy ensef, bikos e nor gri obey God again. E enter God Temple kon offa incense for di altar.


But King Hezekaya nor dey honbol again, bikos e kon dey karry body wey make God vex for both en, Judah and Jerusalem pipol.


King Neko send messenjas go meet am sey, “Judah King! Wetin make yu dey oppoz mi? I nor dey attack yu, na di kingdom wey I follow get war I kom meet and God sey make I hurry. God dey my side, so make yu nor oppoz mi or God go distroy yu.”


So Moses tell Fero, “I go dey happy to pray for yu, yor savants and yor pipol, so dat di frog go komot from yor land go back to di river. So na wish time yu wont make I pray.”


Pesin wey dey kwik vex, naim dey first kause fight; but kwayet pesin dey kwayet for evriwhere.


Pride dey bring distroshon and sturbones fit kill pesin.


To start kworel bi like wen yu leave wota make e dey rush; so e go good make yu stop am, before e go kause big wahala.


Na only foolish pesin dey start kworel; so di rite tin to do, na to run from am.


Nor kwik karry matter go kourt, bikos if anoda witness show sey na yu dey wrong, den, na wetin yu go do?


Pesin wey go argue matter wey nor koncern am, bi like wen yu dey waka for road kon go hold dog for en ear.


Nor argue with pesin just bikos yu won argue, wen yu know sey e nor do yu bad.


Yu do betta business kon get plenty gain and naw, yu dey make mout kon dey karry body up, bikos of yor money!


“Na yu I dey tok about before wen I tell my savant wey bi Israel profet sey, ‘For dat day, I go ask somebody make e attack Israel. God wey get pawa don tok.’ ”


“Man pikin tok against Gog, dat wiked prince wey dey rule Meshak and Tubal wey dey Magog land.


I go drag Persia, Ethiopia and Libya sojas follow dem; plus all di swod wey dem karry.


E go dey happy for en viktory and all di many sojas wey e kill, but e nor go always dey win.


Si proud pipol, all wetin dem dey do nor dey good for my eye. But doz wey dey do good, go get long life, bikos dem dey obey my laws.


True-true, wine go disgrace proud and wiked pipol! Dia mout wide like grave and just as deat nor dey beleful, na so too nor-tin dey beleful dem. Bikos of dia long-trot, dem don gada nashons kon swallow many pipol.


make una nor kon dey do like sey una too important, den forget di Oga una God wey bring una kom out from Egypt where una for bi slaves before.


Any biliver wey poor, make e happy, bikos God don lift am up.


But E give us plenty grace. Na dis make God word sey, “God dey against pesin wey dey karry body up, but E dey give grace to pipol wey dey put dia body down.”


Wen Abimelek kom attack di towa, e go di door won kon lite fire put,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ