Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 13:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 King Jehoahaz nor get any sojas, escept fifty men wey fit use horse, ten shariot and 10,000 sojas for groun. Siria king don kill and mash all en men like san-san.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 13:7
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I skata and turn dem to san. I dey waka on-top dem like mud for street.


So di king koll di 232 yong sojas wey dey under di district kommander. Den e koll all Israel sojas and dem bi 7,000 men.


Israel pipol gada kon ready diasef; dem mash go kamp for two group kon face Siria pipol. Israel pipol bi like small-small goat, bikos Siria pipol plenty kon full evriwhere for di kountry.


For dat time, God kon dey reduce di land wey Israel pipol get. King Hazael for Siria kollect Israel pipol land


Di remainin tins wey Jehoahaz do, plus all wetin e get, dem rite dem for Israel kings history book.


Hazael kon ask am, “My oga, wetin make yu dey kry?” Elisha ansa, “Na bikos I know di kind trobol wey yu go kause for Israel pipol. Yu go burn dia propaty, kill dia yong men, distroy dia shidren and wimen wey get belle, yu go kut dia belle open.”


I grind dem till dem turn to dust kon swip dem enter gutta like dirty.


I go make agriment with una bikos of di king. I go give una 2,000 horse, as long as una get who go ride dem.


Na who raiz di raitious Pesin kom from east kon make am stand and rule ova nashons and kings? With en swod, e turn dem to dust and with en bow, e make dem bi like grass wey breeze dey blow.


Plenty-plenty pipol dey Judgement Valley. For der, God day go soon kom.


I go turn against una kon make una enemies win and di pipol wey hate una, go rule una. Fear go katch una sotey una go dey run wen nobody dey porshu una.


God sey, “Damaskus pipol don too sin, so I go ponish dem naw, bikos dem flog Gilead pipol with stik wey get iron tit.


“I send diziz kom meet una like di one wey happen to Egypt pipol. I kill una yong men for war kon skata una horse. I allow dead body dey smell for una kamps, but una nor still gri turn kom meet mi.” Na so Oga God tok.


Den Samuel go Gilgal and from der to Gibeah for Benjamin. Saul shek di sojas wey still dey with am and dem bi like six hundred.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ