Jehoash wey bi Jehoahaz pikin kon kollect all di land wey Ben-Hadad papa, Hazael, don take from en papa hand for war. Jehoash win three times kon kollect all di land and towns wey bi Israel pipol own.
E bring Israel borda kom back from Lebo-Hamat for nort go rish Arabah wotaside for sout, just as di Oga, Israel God tok thru Profet Jonah wey en papa bi Amittai, wey bi profet for Gat-Hefa.
so Yu kon allow dia enemies win and rule dem. But wen dem koll Yu for help wen dem dey trobol, Yu ansa dem from heaven. Bikos of yor great mesi, Yu send leaders wey kom save dem from dia enemies.
If yu keep kwayet for dis time, God go send help kon from heaven and wi go dey save, but yu go die and yor papa family go end. Yu know weda na bikos of dis tin, na-im make yu bi kween!”