So, King Asa karry all di silva and gold wey remain for di temple and di palis kon give dem to some of en ofisas with dis message, go Damaskus go give King Ben-Hadad for Siria. Na Tabrimmon bi Ben-Hadad papa and na Hezion born Tabrimmon.
But God look Israel pipol kon sorry for dem. God help dem, bikos of di promise wey E make with Abraham, Isaak and Jakob. Till today, E nor like to distroy or remove dem from en present.
Jehoash wey bi Jehoahaz pikin kon kollect all di land wey Ben-Hadad papa, Hazael, don take from en papa hand for war. Jehoash win three times kon kollect all di land and towns wey bi Israel pipol own.