22 So, thru-out di time wen Jehoahaz dey rule Israel, King Hazael for Siria dey opress dem.
Anybody wey eskape and Hazael nor fit kill-am, Jehu go kill-am and anybody wey eskape from Jehu, Elisha go kill-am.
For dat time, God kon dey reduce di land wey Israel pipol get. King Hazael for Siria kollect Israel pipol land
Hazael kon ask am, “My oga, wetin make yu dey kry?” Elisha ansa, “Na bikos I know di kind trobol wey yu go kause for Israel pipol. Yu go burn dia propaty, kill dia yong men, distroy dia shidren and wimen wey get belle, yu go kut dia belle open.”
Hazael ansa, “How e won take happen, bikos I nor even betta rish dog?” Elisha ansa, “God don show mi sey yu go bi Siria king.”