12 Di remainin tins wey Jehoash do, plus all wetin e get, dem rite am for Israel kings history book.
Evry oda tin wey Jeroboam do, di war wey e fight and how e rule, dem rite dem for Israel kings history book.
Di remainin tins wey King Ahazaya do, dem rite dem put for Israel kings history book.
E nor obey God kommand. E bad like Nebat pikin, Jeroboam wey make Israel pipol sin.
Jehoash die and Jeroboam kon take-ova as king. Dem beri am with di kings for Samaria.
E bring Israel borda kom back from Lebo-Hamat for nort go rish Arabah wotaside for sout, just as di Oga, Israel God tok thru Profet Jonah wey en papa bi Amittai, wey bi profet for Gat-Hefa.