So King Jehoash koll Jehoiada with oda priests kon sey, “Wetin make una neva ripair where spoil for di Temple? Naw, make una nor take any money again escept una won use am ripair di Temple.”
But Jehoiada take one box kon kut hole put for en top and put am for di rite side for di altar where dem dey pass enter God house. Den di priest wey dey di temple gate, go pak and put all di money inside di box.