Jehoash tell di priests, “All di silva wey dey God Temple, di ones wey dem kollect wen dem dey kount di pipol, all di silva wey dem kollect as vow and di ones wey pipol just drop on dia own, make una use dem ripair di Temple.
E gada di priest and Levi pipol kon orda dem sey, “Make una go Judah towns go kollect plenty money kom from di pipol make wi take ripair God Temple.” E sey make dem kwik-kwik kollect am, but Levi pipol nor kwik rish der.
Una pipol go build wetin don skata since, dem go build am put for di old foundashon again. Dem go know una as pipol wey ribuild di wall and house wey dem bin skata.”
“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Wen man don give ensef to God to take fulfil di special vow wey e make, di pesin go dey free afta e don pay dis money,
Di first-born wey dem give to God, weda na human being or animal, go bi yor own. But di first-born for pipol and di first-born from man animal wey nor dey klean, dem must replace am.