Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 12:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 King Jehoash for Judah kollect all di holy tins wey en grand-grand papa Jehoshafat, Jehoram and King Ahazaya keep for di Temple for Judah, plus di holy tins wey en ensef keep and all di gold wey dey for God Temple and di king palis kon send dem go give King Hazael for Siria, so dat e nor go kom attack Jerusalem again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 12:18
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

All di good tins wey dey di temple and di gold shield wey Solomon make, di king karry dem go Egypt.


So, King Asa karry all di silva and gold wey remain for di temple and di palis kon give dem to some of en ofisas with dis message, go Damaskus go give King Ben-Hadad for Siria. Na Tabrimmon bi Ben-Hadad papa and na Hezion born Tabrimmon.


Di remainin tins wey Jehoash do, plus all wetin e get, dem rite dem for Judah kings history book.


Jehoash tell di priests, “All di silva wey dey God Temple, di ones wey dem kollect wen dem dey kount di pipol, all di silva wey dem kollect as vow and di ones wey pipol just drop on dia own, make una use dem ripair di Temple.


All di gold, silva, di tins for God temple, di palis and evry oda tins wey dem seize from war, e kon karry dem go back to Samaria.


Den King Ahaz take silva and gold wey dey God Temple and di palis go give Assyria king.


Hazael kon ask am, “My oga, wetin make yu dey kry?” Elisha ansa, “Na bikos I know di kind trobol wey yu go kause for Israel pipol. Yu go burn dia propaty, kill dia yong men, distroy dia shidren and wimen wey get belle, yu go kut dia belle open.”


King Asa take all di silva and gold wey dey di temple and di royal palis kon send dem with message go give King Ben-Hadad for Siria, wey dey rule Damaskus sey:


Wen Priest Jehoiada don die, Judah leaders kon visit di king, bikos of dia respet for Jehoiada. Di king kon listin to dia advise.


Una take my gold and silva kon karry all my betta-betta tins go una temple.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ