Di king kon orda Hilkaya wey bi di High Priest, di priest wey follow am and di guards sey, evritin wey dem take dey woship Baal and Asherah juju and all di stars wey dey God Temple, make dem bring am kom out. Di king burn dem outside Jerusalem for Kidron Valley kon karry dia ashes go Bethel.
So Naaman ansa, “Abeg make yu take silva wey heavy rish one hundred and fifty pounds.” E beg Gehazi well-well kon pak am inside two bags with two difren klot. Naaman give dis tins to two of en savant make dem karry am follow Gehazi.
Kore wey Ebiasaf born, na-im pikin Shallum, with Korah pipol dey guide di door-mot for di tent where God present dey, just as dia grand-grand papa do before.
Anytime wen Levi pipol si sey di box wey di royal money dey don full, doz wey dey kount di money go remove all di money kon karry di box go back to di gate. Na so dem dey do am evriday, until dem kollect plenty money.
So di pipol give money to take pay doz wey dey mold block with di karpenters. Dem send food, drink and olive oil go Tyre and Sidon, so dat dem go give dem cedar trees from Lebanon. Dem karry di trees pass Joppa wotaside and na King Cyrus for Persia allow dem do all dis tins.