5 kon kommand dem sey, “Dis na wetin una go do. Una wey dey kom work for Sabat Day, make una divide unasef into three group. One part go dey protet di king palis,
di food wey dem serve for di tabol; di house wey en ofisas dey stay; how en workers dey do and di uniform wey dem wear; di savants wey dey serve wen dem dey do party and di sakrifice wey e dey offa for di temple. All dis tins kon sopraiz di kween well-well and fear katch am.
So, en, di sojas oga, di guards oga and di pipol kon take di king from di Temple go di palis thru di royal bodyguard gate, den di king kon sidan for di throne.
Di roof wey dem build for di temple and for di door-mot where di king dey pass enter inside for Sabat Day, e remove am too. E take dem komot, bikos e wont make Assyria king, happy.
Na dem dey kare for di tent where dem for dey meet and di holy place. Dem still dey help dia brodas wey bi Aaron shidren-shidren, wey dey serve for God Temple.