Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 10:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 For morning, Jehu go stand near di head dem. Den e kon tell all di pipol, “I gri sey una nor do anytin, bikos na mi set trap for my oga di king kon kill-am. But na who kill all dis men?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 10:9
7 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jehu rite anoda leta go give dem sey, “If una really dey my side and una ready to obey mi, den tumoro, make una karry una oga sons head kon meet mi for Jezrel.” King Ahab born seventy sons and na doz wey dem respet well-well for di town, dey kare for di sons.


Di messenja kon tell Jehu, “Dem don bring di king sons head kom.” Jehu ansa, “Make yu hang dem put for two stik for di town gate till tumoro morning.”


Di pipol wey kill-am na Jozaka, wey Shimeat born and Jehozabad wey bi Shoma pikin. Dem beri am with en grand-grand papa dem for David Town. En pikin, Amazaya kon take-ova as king.


So, my love sey, “Jerusalem and Judah pipol, make una judge between mi and my vineyard.


God tell Hosea, “Make yu koll am ‘Jezrel,’ bikos e nor go tey before I go ponish Israel king, bikos of di pipol wey dia grand-grand papa Jehu kill for Jezrel. I go skata Israel kingdom rish groun.


Naw, as I dey here so, anybody fit tok bad about mi before God and di king wey E choose? I don use force take anybody animal? I don do anybody wrong? I don opress anybody? I don take bribe from anybody hand wey make mi nor tok trut? Make una tell mi and I go ansa una!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ