Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 Kings 10:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

31 But Jehu nor obey di Oga, Israel God with en whole heart; instead e kon dey sin like Jeroboam wey make Israel sin.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 Kings 10:31
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God go abandon Israel pipol, bikos King Jeroboam don make di pipol sin.”


If yu obey dem, God go keep en promise wey E make wen E tell mi sey, ‘My shidren-shidren go rule Israel as long as dem dey obey my kommand with all dia heart and soul.’


But Jehu kon dey sin like Jeroboam, Nebat pikin, wey make Israel sin as dem dey woship di juju wey dey Bethel and Dan.


Israel pipol kon dey sin like Jeroboam, Nebat pikin and dem nor gri turn kom meet God.


But just like Jeroboam, Nebat pikin wey bi king before am, e still kontinue to lead and enkourage Israel pipol to sin.


My Oga wey bi Israel God, make Yu do wetin Yu promise yor savant, my papa David, wen Yu sey, ‘Na yor shidren and shidren-shidren go dey rule for Israel, so-far dem do wetin I tok kon obey my laws, just as Yu obey mi.’


join hand with awa leaders kon swear sey, make curse dey awa head if wi nor live akordin to God law. Di law wey E give us thru en savant Moses wen e sey make wi obey evritin wey di Oga awa God kommand us kon keep all en rules and regulashons.


Di only way yong pesin go if live betta life, na to obey God word.


I tell mysef sey, “I go dey kareful for wetin I dey do and I nor go sin with wetin I dey tok. I go hold my tongue wen sinnas dey near mi.”


bikos dem nor gri keep God kovenant or obey en kommandment.


Make yu dey kareful about wetin yu dey tink, bikos na wetin yu tink for yor heart, yu go do.


I go give una my spirit kon make sure sey una dey follow my laws and keep all di kommandment wey I give una.


Wi nor dey obey di Oga awa God, bikos wi nor dey live awa life as E sey make wi leave am. Wi even bilive sey di law wey E sey make en savants tell us, nor mean anytin.


But make una dey kareful, bikos una nor know as God bi even wen E dey tok to una for Mount Sinai from inside di fire.


So make una dey kareful, so dat una nor go break di kovenant wey una make with di Oga una God. Make una nor make any juju for unasef, bikos una God nor like am.


Make una dey do just as E kommand una, so dat una nor go die; evritin go dey well with una and una go stay long for di land wey una dey go.


Make una make sure sey nobody turn back from God grace and make nobody get bad belle and kause trobol wey go make pipol sin.


Make wi listin to wetin wi don hear, so dat wi nor go fall komot from di rite road.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ