Jesus ansa, “My kingdom nor dey dis world. If to sey my kingdom dey dis world, my savants for fight make I nor kom meet di Jew oga dem. But as e bi so, my kingdom nor dey here.”
Samuel tell di pipol, “Una don si di pesin wey God don choose? True-true, nobody bi like am for di whole Israel!” All di pipol kon shaut, “Di king go stay forever!”
So di pipol kon go Gilgal, di place where dem for make Saul dia real king for God present. Dem offa peace ofrin give God for der. Saul and evribody for Israel kon dey happy.