Di king kon sey make dem koll Abraham kom. Wen dem koll am kom, di king kon tell am, “Wetin bi dis wey yu do so? Na wish kind bad tin I do yu, wey yu won make mi and my kingdom kommit dis kind big sin? Yu don do sometin to mi wey yu nor suppose do!”
Aaron kollect and melt di gold kon mold melu for dem. Wen di pipol si di melu, dem kon sey, “Israel pipol, dis na di god wey lead us komot from Egypt.”
E still dey do ashawo and na from Egypt e for start to sleep with difren pipol. Na since e yong, men don dey sleep with am and dem dey trit am like ashawo.