Di pipol kon go skata dia juju, di juju house dem and en altar. Dem kill Mattan wey bi di juju priest for di altar front. Jehoiada kon put guards for di Temple.
E distroy di high place dem with dia juju, shrine and Asherah juju. E still distroy di bronze snake wey Moses make, bikos till dat time, Israel pipol still dey offa sakrifice gi-am. Dem dey koll am, “Nehushtan.”
So, I kommand sey if any of una nor obey dis orda, dem go komot one wood pila from en house, sharp one side, den take am shuk di pesin die. And dem go turn di house to where dem dey trowey dirty put.
Di king ansa di wise men, “I don tok for my mind sey una go tell mi my dream and wetin e mean. But if una nor fit tell mi di dream and wetin e mean, den I go make sure sey dem kut una to pieces kon skata una house!
Naw, I dey kommand sey evribody for dis land wey go tok anytin against Shadrak, Meshak and Abednego God, dem go kut am, just as dem dey kut leaf kon distroy en house.”
I go distroy di place where una for dey woship on-top di hills kon skata una incense altars, den kill and trowey una dead body near una juju wey don fall. I go rijet una finish.
Una go burn dia juju for fire and una must nor like dia gold or silva. Una must nor take dem, if not dem go bi trap for una, bikos dem nor dey good to di Oga una God.