22 Jehu orda di pesin wey dey keep di garments, “Make yu give garment to all dis pipol.” So, e bring garment kom for dem.
Jehu invite all di pipol wey dey serve juju for Israel and all of dem kom di party. Pipol full di juju temple from front go rish back.
Den Jehu and Rekab pikin, Jehonadab kon go di juju temple. Jehu tell di pipol, “Make una make sure sey nobody wey dey serve God dey here with una; bikos na only doz wey dey serve juju must dey here.”
Make yu make special garment for yor broda Aaron, wey go gi-am beauti and honor.