20 Den Jehu orda sey, “Make una go arrange big feast for Baal juju.” So dem kon announce am.
Dem choose one day to fast kon make Nabot di leader among di pipol.
Aaron kollect and melt di gold kon mold melu for dem. Wen di pipol si di melu, dem kon sey, “Israel pipol, dis na di god wey lead us komot from Egypt.”
Aaron si as di pipol dey happy, so e build altar for di melu front kon sey, “Tumoro go bi Oga God Feast.”
Koll and tell evribody sey make dem fast! Gada di leaders and all Judah pipol go meet and kry give God for en temple!
Make una blow di trumpet for Mount Zion; koll di pipol gada kon orda sey make dem fast!