12 Jehu leave der kon go Samaria. As e dey travel pass Bet-Eked (where doz wey dey guide sheep dey kamp put),
Den Jehu kill di odas for Ahab family wey dey Jezrel, plus all en ofisas, klose friends and priests. E nor leave any one.
Jehu meet some pipol wey rilate to King Ahazaya for Judah. Jehu kon ask dem, “Who una bi?” Dem ansa, “Wi bi King Ahazaya family membas. Wi dey go Jezrel go greet Kween Jezebel and di odas for di palis.”
Jehu kon sey, “Make una katch dem kom!” So dem katch dem and Jehu kill all of dem for Bet-Eked pit, (na forty-two dem bi).
As Jehu dey distroy Ahab family, e kon si Judah pipol ofisas, Ahazaya sons and en relashon wey dey serve am. So Jehu kill all of dem.