1 Ahab get seventy sons for Samaria. So Jehu rite and send leta go give di sojas oga and doz wey dey guide Ahab shidren. Dis na wetin e rite for di leta:
“Yu don si how King Ahab honbol ensef for mi since wen yu tell am wetin I tok? I nor go bring wahala kon gi-am wen e still dey life, but na en pikin go take head karry am.”
Dem find Ahazaya until dem si am for where e hide for Samaria. Dem bring am kon give Jehu and e kill-am. Dem just beri en body, bikos dem dey respet en grand-papa, King Jehoshafat, wey use all en mind take serve God. E nor get anybody for Ahazaya family wey remain to rule as king.
God tell Hosea, “Make yu koll am ‘Jezrel,’ bikos e nor go tey before I go ponish Israel king, bikos of di pipol wey dia grand-grand papa Jehu kill for Jezrel. I go skata Israel kingdom rish groun.
Nor bi mi kreate or born dem o-o! Why Yu go tell mi sey make I kare and karry dem for my hand like sey dem bi small pikin? Na so I go take karry dem go rish di land wey Yu promise dia grand-grand papa?