Dem ansa, “One man tell us, ‘Make una go back go tell di king sey, “Dis na wetin God tok: Wetin make una won go ask Baal-Zebub wey bi Ekron god? Na bikos una tink sey Israel pipol nor get God? So di king nor go stand up from di bed wey e dey so, bikos e go die.” ’ ”
Den, Gideon ask Zebah and Zalmunna, “Di men wey una kill for Tabor, make una tell mi how dem bi!” Dem ansa, “Dem bi like yu, all of dem bi like king pikin.”
Di king ask di woman, “Na how e look like?” Di woman ansa, “Na old man dey kom so-o! Dem wrap en body with klot!” Den Saul know sey na Samuel and e kon bow face groun.