“Make una shine una eye. Dem go take una go kourt and dem go beat una for sinagog. Bikos of mi, una go stand for govnors and kings front, so dat una go fit tell dem about mi.
Jesus ansa, “Make una shine una eye, so dat nobody go deceive una. Bikos many pipol go kom prish with my name sey, ‘Na mi bi Jesus’ or ‘Di time don near.’ Make una nor follow dem!
God go reward di pesin wey plok plenty fruit from wetin odas plant and e go get life wey nor dey end. So, di pesin wey plant and di pesin wey plok wetin dem plant, go happy togeda.