Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




2 John 1:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Even doh I get many oda tins wey I won tell una, I nor won take paper and biro rite dem, but I hope sey I go kom visit una and I go tok to una face-to-face, so dat awa happiness go full.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




2 John 1:12
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So I go tok with am face-to-face and nor bi with word wey e nor go undastand and e go si as God bi. So wetin make una nor dey fear to tok against my savant Moses?”


I don tell una all dis tins, so dat my joy go dey inside una and una joy go full well-well.


“I get plenty tins wey I won tell una, but una nor go fit bear dem naw.


Before naw, una neva take my name ask for anytin. Naw make una use my name ask for anytin wey una wont and una go get am, so dat una joy go full well-well.


Since I dey kom meet yu, I dey tok all dis tins for di world, so dat dia joy go full well-well.


Di pesin wey won marry new wife naim bi di bridegroom. En friend, wey bi di best man, dey listin to am. E go dey happy well-well wen e hear di bridegroom dey tok. Na dis dey make mi happy and my joy don full.


I go plan to stop si una wen I dey go Spain, so dat una go help mi for di journey, afta I don stay with una for sometaim.


Wen I remember as yu take kry, e dey hongry mi to kom si yu, so dat joy go full my mind.


So, make yu prepare where I go stay, bikos I know sey yor prayers go make dem free mi kom meet yu soon.


Abeg, make una pray well-well, so dat dem go free mi and I go fit kom meet una soon.


Make una know sey dem don release awa broda Timoti from prison. If e kwik kom, e go follow mi kom si una.


Na dis make us dey rite dis leta, so dat awa joy go full well-well.


So, wen I kom, I go tell evribody wetin e do; tins wey wi nor do and e sey wi do am. Even doh e dey tok bad about us, dat one nor do for am; nor bi only sey e nor dey welkom awa brodas, but e dey make odas nor welkom dem too and e dey drive dem komot from di church.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ