Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Timoti 6:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 If anybody dey tish wetin nor korrect and nor gri with awa Oga God Jesus Christ tishing and as God wont make wi dey live awa life,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Timoti 6:3
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Gentol word na tree wey dey give life, but lie-lie tongue dey make di spirit weak.


Dem ansa, “Na Caesar own.” Jesus kon tell dem, “Den, make una give Caesar wetin bi Caesar own and give God, wetin bi God own.”


dey tish dem to do evritin wey I tish una. I go always dey with una until di world go end.”


Naw, my brodas and sistas, I dey beg una, make una know di pipol wey dey kause wahala and oppoz di tishing wey una don learn from us. Den make una nor go near dem!


So, anybody wey rijet wetin wi tok; nor bi human being authority e rijet, but na God wey give una en Holy Spirit.


Di law na for pipol wey dey sleep with who dem nor marry; man wey dey sleep with man; woman wey dey sleep with woman; pesin wey dey sell pipol as slave; lie-lie pipol; doz wey dey promise and dem nor fit do am or anybody wey nor dey obey di rite tishings


As I tell yu wen I dey go Masidonia, make yu korrect doz pipol for Efesus wey nor dey tish di trut


Some disobey dis kommand kon dey tok tins wey nor dey good.


Make yu kontinue with di word wey I tell yu kon dey do am with di faith and love wey dey inside Christ.


Bikos time dey kom wen pipol nor go won hear good and betta tishing again. Instead, dem go dey follow wetin dey hongry dem to do kon dey find tisha wey go tish dem wetin dem won hear.


Na Paul, wey bi Jesus Christ apostle and God savant rite dis leta to help pipol wey God don choose, so dat dia faith go strong kon know di trut wey go help dem live di kind life wey God wont.


E must bilive di message about God wey e dey tish, so dat e go fit tell pipol di trut and korrect doz wey dey oppoz am.


Dis word wey I dey tok so na trut and I wont make yu make sure sey evribody wey trust God dey do good. Dis tishing dey good and e go help evribody.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ