Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Timoti 6:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Una wey bi savants, make una dey respet una masta, so dat nobody go tok bad about God and wetin wi dey tish.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Timoti 6:1
35 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den di angel tell am, “Go back go meet yor madam make yu respet am.


E kon pray, “My Oga God, wey bi my masta Abraham God, make Yu guide mi today. Make Yu dey good to my oga Abraham.


One day, Abraham tell en savant wey old pass, di one wey dey guide di house sey, “Make yu put yor hand under my lap.


E kon sey, “Make praiz bi God own, my oga Abraham God, bikos Yu don show mi yor love wey nor dey fail and as Yu dey good to my oga family.”


But bikos yu show God sey yu dey sorry for wetin yu do, yor pikin go die.” Den Natan kon go en house.


Den en savants go tell am, “Awa oga! If to sey di profet sey make yu do one big tin, yu nor go rush go do am? So dis one wey e sey make yu do, nor hard at-all, just go wosh yor body, so dat yu go well.”


Levi pipol: Jeshua, Kadmiel, Bani, Hashabneaya, Sherebaya, Hodaya, Shebanaya and Petahaya kon tell di pipol sey, “Make una stand praiz di Oga una God bikos E dey forever and ever!” Den dem pray sey, “Wi go praiz yor holy name! Make yor name high pass evry blessing and praiz!


I bin dey vex for my pipol and na dat make mi allow yu attack dem; but yu nor sorry for dem at-all and yu even dey ponish di old pipol among dem.


Di same tin don happen naw for Babilon, una don bi slave and dem nor pay anytin for una head. Pipol wey dey rule una dey make mout and dem dey always use my name make yeye.


Nor bi dis kind fasting I choose; but wetin I wont bi sey: ‘Make una remove sin from una body kon give betta judgement, den free pipol wey una dey opress.


Dem dey disgrace my holy name for anywhere wey dem go, bikos pipol dey sey, ‘Dis pipol don komot from di land wey dia own God, give dem.’


Wen I show di kountries how my name dey holy and great rish; di name wey una dey disgrace, dem go know sey na mi bi God. Mi, God wey get pawa, don tok.” “I go use una take show di kountries sey I dey holy.


Oga God ask di priests, “Pikin dey honor en papa and savant dey respet en masta, but wetin make una nor dey honor mi wey bi una papa? If I bi una masta, why una nor dey respet mi? Una nor dey respet mi, yet una dey ask, ‘How wi nor take dey respet Yu?’


My way eazy to follow and my load nor heavy to karry.”


Wetin una go si for outside? Na profet? Yes! I tell una, e even big pass profet.


Jesus tell en disciples, “Tins wey go make pipol kommit sin must happen, but e go bad well-well for di pesin wey go make dem happen!


Dem ansa, “Kornelius, di soja offisa, wey dey do good tins and dey woship God well-well, wey all Jew pipol dey respet, na-im send us kom. One angel kommand am sey make e invite yu kom prish gi-am.”


Wen di angel don go, Kornelius kon koll two of en house boys with one soja wey dey serve am


So why una won kon try God? Load wey wi and awa grand-grand papa dem nor fit karry, why una dey put am for dis disciples head?


Just as God word sey, “Bikos of una wey bi Jew pipol, Gentile pipol dey take God name make yeye.”


Live yor life so dat yu nor go kause trobol for Jew or Greek pipol or for pipol wey dey God church.


Make una nor dey karry load for head like slave again, but make una stand strong for groun, bikos Christ don make us free.


una go-go serve una enemies wey God go send against una. Una go dey hongry; una nor go si wota drink or get klot to wear and una nor go get anytin at-all. God go put load like iron for una neck wey go press una well-well until e don distroy una.


So I wont make di yong wimen marry; born shidren; dey guide dia house, so dat enemies nor go get shance to akuiz dem.


to dey kontrol diasef; get pure mind; dey do dia house work well; dey kare for pipol; dey do as dia husband wont, so dat pipol nor go tok anyhow about God word wey wi dey prish so.


So make una dey live well among pipol wey nor bi Christian, so dat wen dem sey una do bad, dem go si di good tins wey una dey do and dem go praiz God wen E won judge di world.


But make una do am with gentolness and respet, dey make sure sey una mind klean, so dat pipol wey dey tok bad about di good tins wey una dey do for Christ, go shame for di bad wey dem dey tok.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ