True-true, dem nor many wen I kom, but naw, wetin yu get don plenty well-well. God don bless yu for evriwhere wey I for work for yu. But naw, how long e go take before I go do sometin for my own family?”
Make una share una food with pipol wey dey hongry kon open una door for poor pipol wey nor get house. Den give klot to pipol wey nor get anytin to wear and help una own rilashons.
If e nor asept wetin dem tok, make yu tell di church leaders. If e nor gri listin to wetin di church leaders tok, den make una trit am like sina or tax kollector.
Si, for di third time, I don ready to kom visit una and I nor go put my load for una head, bikos na una I wont and nor bi wetin una get. Nor bi pikin suppose pay for dia papa and mama food, but na papa and mama, dey pay for dia pikin food.
Dis kind pipol dey sey dem know God, but di way wey dem dey live dia life, show sey dem nor know am, bikos dem get bad mind, dey disobey God and dem nor ever dey like betta tin.
As fake profets dey among di pipol before, na so fake tishas go dey among una too. Dis fake tishas go tish lie-lie tins wey fit distroy pesin and dem go sey dem nor know di Masta. Like dis, dem go distroy demsef.
Some pipol don hide join una and God don mark dem for distroshon. So I won tell una about dis tins sey, dis pipol nor dey fear God. Dem don dey use God grace as eskuse to dey do bad-bad tins. Dis pipol nor gri asept Christ as dia Masta and Oga God.
I know sey yu dey stay for where Satan throne dey. But yu still whole my name strong well-well and yu nor deny mi even wen dem kill my savant Antipas for where Satan dey stay.
I know evritin wey yu dey do. (Si, I don open door for yu wey nobody go fit klose.) I know sey yu nor too get pawa, but yu don obey my word and yu nor deny mi at-all.