19 Make yu nor asept any words wey dem tok against any leader, unless two or three pipol bear witness sey na true.
But if e nor asept wetin yu tok, take one or two pipol follow body go meet am, bikos matter wey two or three pipol tok put, naim betta pass.
So Pilate kom meet dem for outside kon ask dem, “Wetin una sey dis man do?”
God word sey, ‘Wetin two pipol bear witness about, na true.’
Afta dem don kontribute, dem kon send Banabas and Saul go give di eldas di money wey dem gada.
But I ansa dem, ‘Rome law nor gri make dem kondemn anybody wen e neva face and defend ensef before pipol wey dey akuiz am.’
Na di third time wey I dey kom visit una bi dis. If dem sey pesin do bad, two or three pipol must sey, na true, before pipol go bilive am.
But make una nor ever kill pesin, bikos of wetin one pesin tok. Two or three pesin must tok di same tin, before una go fit stone pesin die.
Make una nor hold anybody sey e do bad, if na only one pesin bi witness. Di trut for di matter bi sey, two or three pesin must sey dem si wetin happen.
Nor stop to dey use di spiritual gift wey yu get; bikos yu get am thru profesy, wen eldas put hand for yor head dey pray.
Doz wey dey lead well, make dem pay dem well, especially doz wey dey work and tish well-well, so dat di gospel go stand.
Anybody wey won bi elder must dey good. E must get only one wife and en shidren must bi bilivers; dey gentol and dey respet demsef.
Wen two or three pipol bi witness sey somebody rijet Moses Law, dem go kill-am without sey dem sorry for am.