Dem dey tish sey, e nor good to marry or chop some kind food. But na God kreate dis food and E sey pipol wey bilive di trut fit chop am afta dem don tank am.
But yong woman wey en husband just die, make una nor put am join doz wey di church dey help, bikos wen dem dey hongry to marry again, dem go fit leave Christ kon bigin sin.
to dey kontrol diasef; get pure mind; dey do dia house work well; dey kare for pipol; dey do as dia husband wont, so dat pipol nor go tok anyhow about God word wey wi dey prish so.
Make evribody respet marriage: una must make sure sey una nor sleep with who nor bi una husband or wife, bikos God go judge pipol wey dey sleep with who dem nor marry and pipol wey don marry, wey dey sleep with oda pipol.