but dey waste oda pipol time with di words wey dem dey tok. Dis kind tin dey make pipol live yeye life, instead of to dey hear God word wey dey make pesin faith strong.
God nor give di law, bikos of good pipol, but na for pipol wey dey disobey and do anyhow. Dis kind pipol dey like to sin and dem nor dey fear God. Dem nor dey holy or get respet for anytin and dem fit kill dia papa, mama or anybody.
Wi know sey God ways dey great well-well: Christ kom as human being; di Spirit show sey e dey free; angels si am wen e kom prish among Gentile pipol; pipol bilive am for di world and God karry am go heaven with glory.
But yu wey dey serve God, make yu nor put hand for all dat kind tin. Instead, make yu dey struggol to do wetin dey rite and good; dey keep yor promise; dey love; get patient and dey gentol.
Timoti, make yu guide wetin God give yu well-well. Nor put yor mout for yeye tins or matter wey pipol wey nor know God dey tok and do, bikos dem dey oppoz yu with wetin dem feel sey dem know.
Di grace dey tish us sey, make wi nor live like pipol wey nor know God or dey bihave anyhow. So make wi dey kontrol awasef; dey do good and follow God for dis time wey wi dey so,
Nor put mout for word wey nor dey good: like matter wey koncern who born who and kworel or fight about Jew pipol law. All dis tin dey yuzles and dem nor mean anytin.