Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Timoti 4:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Bikos evritin wey God kreate, dey good and wi nor suppose rijet any food, so-far wi don tank God for am,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Timoti 4:4
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So God si evritin wey E kreate and dem good well-well! And dat evening and morning kon make am di sixt day.


But di vois tell am, “Wetin God don make klean, make yu nor forbid am.”


‘Wi advise sey make una forbid meat and blood wey dem don sakrifice give juju and any animal wey una kill wey en blood nor tosh groun. And make una nor sleep with who una nor marry.’ If una forbid all dis tins, una go do well!”


But for Gentile pipol wey don bilive, wi don rite leta go give dem sey, make dem forbid meat wey dem sakrifice give juju; animal wey dem kill and e blood nor tosh groun and make dem nor sleep with who dem nor marry.”


As I don know Christ, e don make mi know sey all food dey klean. But if yu tink sey e nor good make yu chop some food, dat nor mean sey, e nor good for anoda pesin.


Nor skata God work bikos of food. Evry food dey okay, but e nor good make yu chop wetin go spoil anoda pesin faith.


Anybody wey tink sey one day betta pass anoda, dey do so to honor God. And anybody wey chop meat, dey tank God just like di pesin wey nor won chop.


Pipol sey, wi fit do evritin. Dat na true, but nor bi evritin dey good. Wi fit do evritin, but nor bi evritin dey good for di body.


Make una mind dey okay as una dey chop any meat wey dem dey sell for market.


Bikos God word sey, “Di eart and evritin wey dey inside, na di Oga God own.”


If I tank God for my food, wetin go make anybody fight mi bikos of di food wey I tank God for?


Na-im bi di Rock; evritin wey E dey do dey korrect, bikos wayo nor dey en tins. En na God wey pesin fit bilive, bikos E nor just dey judge pipol anyhow.


Dem dey tish sey, e nor good to marry or chop some kind food. But na God kreate dis food and E sey pipol wey bilive di trut fit chop am afta dem don tank am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ