9 Dem must bi pipol wey get mind and dey prish di trut about di faith wey God don show us.
Whole yor faith for Christ well and make yor mind dey klear. Bikos some pipol nor dey use good mind and bikos of dat, dia faith don skata.
But di rizin why I dey give dis kommand, na bikos I love dem from my heart with betta mind and faith.
Wi know sey God ways dey great well-well: Christ kom as human being; di Spirit show sey e dey free; angels si am wen e kom prish among Gentile pipol; pipol bilive am for di world and God karry am go heaven with glory.