Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Timoti 3:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Like dis too, deakons must bi pipol wey get good karata; nor bi pipol wey dey play wayo; dey drink anyhow or love money.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Timoti 3:8
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Pipol dey lie give each oda; dem just dey deceive demsef.


bikos my enemies nor dey tok di trut. Wetin dey hongry dem to do, na to distroy odas; dia troat bi like open grave and na so-so lie-lie words full dia mout.


Na so-so wiked tins full una mout and na lie-lie full una tongue.


Evriday, na how yu go take distroy pipol yu dey plan. Yor tongue dey kut pipol like razor blade and yu sabi lie well-well.


Priests nor go drink any wine before e go inside di kourt.


“Make yu and yor sons nor drink wine or strong drink wen una enter di tent, so dat una nor go die and dis na law wey yu and yor shidren-shidren must obey.


Na lie wey fit kill pesin full dia mout and wiked words full dia tongue.


Dis leta na from Paul and Timoti, wey bi Jesus Christ savant. To all God pipol for Filippi, with dia bishops and leaders.


Deakons must dey faithful to en wife and must fit kontrol en shidren and evritin for en house.


Leader for church must bi pesin wey nor get fault; wey get only one wife; fit kontrol ensef; get sense and respet; dey welkom pipol and e bi good tisha.


Make e nor bi drunkard or pesin wey like to fight; but e must dey gentol. Make e nor bi pesin wey like to kworel or love money.


Nor dey drink only wota, but make yu still drink small wine bikos of yor belle wey dey make yu sick anyhow.


Make pesin wey bi leader nor get fault, bikos na God work e dey do. Make e nor dey karry body up; dey kwik vex or drink anyhow; dey like to beat pipol or love money.


Make yu tish old wimen sey, make dem live life wey go make God happy. Make dem nor tok bad about pipol; nor dey drink anyhow, instead make dem tish oda wimen wetin dey good.


My brodas and sistas, na di same tongue wi dey use take praiz and curse pipol. But e nor suppose bi like dat.


Make una kare for di sheep wey God give una whole, just as shepad dey kare for dia sheep. Make e nor bi like sey dem force una do am, but na as God wont am. Una nor dey do am bikos of money, but na bikos una won do am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ