Dem ansa, “Kornelius, di soja offisa, wey dey do good tins and dey woship God well-well, wey all Jew pipol dey respet, na-im send us kom. One angel kommand am sey make e invite yu kom prish gi-am.”
So make una look round kon choose among una, seven men wey una know sey dey bihave well; di Holy Spirit dey use well-well and wey get sense, so dat dem go do dis work for us.
Den dia sense go korrect and dem nor go fall enter devil trap again. Bikos devil don katch dem put inside en trap before, so dem dey do anytin wey e wont.
to dey kontrol diasef; get pure mind; dey do dia house work well; dey kare for pipol; dey do as dia husband wont, so dat pipol nor go tok anyhow about God word wey wi dey prish so.
Pipol don tok about Demetrius, bikos e dey do good and even di trut wey e know, show sey e good. Wisef dey tok about how e good and yu know sey wetin wi dey tok, na true.