Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Timoti 3:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Wi know sey God ways dey great well-well: Christ kom as human being; di Spirit show sey e dey free; angels si am wen e kom prish among Gentile pipol; pipol bilive am for di world and God karry am go heaven with glory.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Timoti 3:16
81 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So, God go give una sign by ensef. One yong woman wey neva ever sleep with man before, go get belle kon born boy pikin and dem go koll am, ‘Immanuel, wey mean, “God dey with us.” ’


Bikos dem don born one pikin for us! God don give us boy pikin! E go bi awa ruler and dem go koll am, “Wonderful Advise, Mighty God, Everlastin Fada and di Prince wey bring peace.”


But yu, Betlehem Efrat yu bi one small town for Judah. But na from yu di pesin wey go rule Israel go from kom and en family dey among Israel pipol since.


“Si! Di woman wey neva sleep with man before go get belle and e go born boy and dem go koll am, ‘Emmanuel’ wey mean, ‘God dey with us.’ ”


Jesus ansa dem, “God don make una know all di sekret tins about en kingdom, but dis pipol nor know.


At wons, strong eartkweke happen, bikos God angel kom down from heaven, roll di stone komot kon sidan on-top am.


As Jesus dey kom out from di wota afta John don baptize am, heaven open and John kon si God Spirit wey bi like dove, stay on-top Jesus head.


So, devil kon leave Jesus and God angels kon bigin help am.


E stay inside di wildaness where Satan tempt am for forty days. E dey der with wiked animals and God angels kon gi-am evritin wey e wont.


Afta Jesus don tok to dem finish, God kon karry am go heaven and e sidan for God rite side.


As dem enter, dem si one man wey wear white klot sidan for di rite side and fear kon katch dem.


Na-im bi di lite wey go show Gentile pipol road kon bring honor to yor pipol, Israel.”


If David koll am ‘Oga God,’ how e kon take bi David pikin?”


One angel appear from heaven kon give Jesus pawa.


As dem dey konfuse bikos of dis tin, dem kon si two men wey dia klot dey shine like lite and dem stand for korna.


As e dey bless dem, God kon karry am go heaven.


Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.


Bikos Jesus know sey en Papa don gi-am pawa to kontrol evritin and as e bi sey e kom from God and e dey go back go meet am,


“But wen di true Spirit wey I go send from my Papa to help una don kom, e go tok about mi.


Na my Papa send mi kom dis world, but naw, I dey go back go meet am.”


And naw, Papa honor mi, make yu draw mi near yu, just as wi dey before di world start.


Den e si two angel wey wear white klot sidan for where dem put Jesus body. One dey for where di head dey and di oda dey for where di leg dey.


Wetin go happen if una si Man Pikin go back to heaven where e dey before?


sotey all di pipol for Jerusalem hear di story and naim make dem dey koll di place for dia language, “Akeldama”, wey mean, “Blood Land”).


Den Pita tell dem, “Naw, I don undastand sey God nor dey opress anybody,


Wen dem rish Antiok, dem gada di pipol kon tell dem all di tins wey God use dem do and how E open road for Gentile pipol to bilive.


Make una take kare of unasef and all di pipol wey di Holy Spirit don put under una, bikos na una bi di leaders for God church wey E buy with en only pikin blood.


Jew and Gentile pipol nor dey difren for God eye and E dey bless evribody wey dey pray to am,


But make I ask, dem neva hear di message before? Yes! Dem don hear am, bikos God word sey, “Dem prish di message and dia vois rish evriwhere for di world.”


Make wi praiz God, bikos e don make una strong thru dis Good News wey I dey prish about en pikin, Jesus Christ. For many years naw, dem keep dis message for sekret,


but naw, dem don tok am at last. God wey nor dey die, kommand en profets make dem rite about di Good News, so dat pipol for evriwhere, go obey am and get faith.


Even doh evry human being dey lie, God nor fit lie. God word sey: “Make yu dey tok wetin bi trut; so dat yu go fit win yor kase wen dem dey judge yu.”


Moses Law nor fit do dis tins, bikos di yeye life wey wi dey live don make di law weak. But God don free us wen E send en pikin kom like human being wey bi sina, make e for sakrifice ensef for awa sins.


Awa grand-grand papa dem wey follow God waka before, na from dem dis pipol from kom. So I dey pray make dem praiz God wey dey rule evritin forever and ever! Amen.


Na san God take make di first man, but di sekond man kom from heaven.


Di tin wey I dey tok about, na God sekret wisdom wey E choose for us, even before E kreate di world.


Bikos God Pikin, Jesus Christ, di One wey mi, Silas and Timoti dey prish give una, nor bi “Yes” and “No.” But from biginnin, na Jesus bi God “Yes.”


(Bikos na thru God pawa Pita take prish to Jew pipol and na di same pawa I take dey prish give Gentile pipol too),


but wen di rite time rish, God kon send en pikin wey woman born under di law,


E do like dis wen E show us di sekret plan wey E get and di good mind wey E show evribody, thru Christ.


Make una pray for mi too sey, make God give mi betta word anytime wen I open my mout to tok and make I fit esplain di sekret wey dey di gospel.


If true-true una get faith and una leg strong for groun, den una go get hope kon whole di gospel wey una hear. Dem don prish dis gospel give evribody for di world and mi Paul don bi di gospel savant.


God wont make dem know di rishis wey dey en glory; wey di sekret get for evribody and na-im bi Christ wey dey inside una. So una get hope sey una go share for God glory.


kom meet una. Dis gospel dey bear fruit for di whole world and since di day wey una hear am, una don undastand as God grace big rish and e don dey bear fruit and grow among una.


Wetin I wont bi sey, wen una don really undastand God sekret wey dey inside Jesus Christ, make una heart dey strong with love, so dat una go get evritin wey una wont.


e go drive sinnas komot from en present, en pawa and en glory. Dat day, evribody wey bilive, go praiz am and true-true, una bilive evritin wey wi tell una.


Dis wikedness don already dey work for sekret and dem go dey sekret until di pesin, wey bi di Holy Spirit wey dey whole dem, go komot for road.


Dem must bi pipol wey get mind and dey prish di trut about di faith wey God don show us.


Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.


Make wi dey look Jesus Christ wey give us awa faith and go help us keep am. Bikos of di joy wey Jesus dey espect, e sofa for cross and nor mind di shame wey follow am. But naw, e don sidan for di rite hand side for God throne.


True-true, wi know sey pesin wey bless pesin, na-im big pass di pesin wey e bless.


Wetin I mean bi sey: Wi get High Priest wey sidan for God rite hand side for heaven.


Dem show sey nor bi demsef dem dey work for, but na for una, bikos una hear dis matter from di apostles thru di Holy Spirit pawa wey kom from heaven. Even angels dey wish sey dem know dis tins.


God choose am before E kreate dis world, but na for dis last days E show am to una.


True am, una bilive God wey raiz am from deat kon gi-am glory. So, una faith and hope dey for God hand.


Bikos of sin, Christ sofa. En wey nor do bad, sofa for doz wey do bad, so dat e go karry us go meet God. And wen dem kill-am, e wake-up as spirit.


go heaven kon go sidan for God rite hand, where e dey rule di angels and doz wey get pawa.


and dis life kom out and wi don si am. Na dis tins wi dey tok about. Wi dey tell una about di life wey nor dey end, wey dey with di Papa for heaven and E don show am to us.


And una know sey God send Jesus kom, make e for karry sin komot and know sin dey inside Christ.


But pesin wey dey like to sin, na devil pikin, bikos devil dey sin from di biginnin. Na dis one make God Pikin kom dis world, so dat e go skata all di work wey devil dey do.


Dem rite one sekret name for en fore head wey bi: “Babilon wey big well-well, ashawo pipol and yeye tins mama.”


But di angel tell mi, “Why yu dey sopraiz like dis? I go tell yu di sekret plan wey di woman and di beast wey karry am, get. Dis na di beast wey get seven heads and ten horns.


Afta all dis tins, I look up kon si crowd wey nobody fit kount. Dem kom from difren tribe, kountry, group, language and dem stand for di throne and di Lamb front. Dem wear white klot kon whole palm tree branches for hand


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ