Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Timoti 2:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Make una pray for kings and doz wey dey rule, so dat wi go fit live for peace, get betta karata and good life with fear for God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Timoti 2:2
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Awa town na big one wey get peace and pipol dey respet us for Israel. Why yu won distroy am? Yu won skata wetin bi God own?”


Una must give dem dis tins, so dat dem go fit offa sakrifice wey God wey dey heaven go asept and pray make E bless mi and my sons.


Make Yu listin to di prayers wey mi and yor savants wey dey honor Yu, dey pray. Make Yu help mi today, so dat di king go sorry for mi.” For dat time, na mi dey serve di king wine.


My God, I beg Yu! Make Yu give di king di sense to dey judge well! Always allow di king pikin dey tok wetin dey korrect!


So my pikin, make yu fear God and honor di king. Make yu nor do anytin with pipol wey dey tok against dem,


Make una work well-well for di town wey I send una go as prisonas and make una pray make I bless dem, bikos if dem prosper, una go prosper too.


Dem dey do wetin God like, dey follow all di tins wey God tok for en word.


One man dey Jerusalem wey en name bi Simeon and di Holy Spirit dey inside am. Di man dey fear God and dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God go free Israel.


Dem ansa, “Kornelius, di soja offisa, wey dey do good tins and dey woship God well-well, wey all Jew pipol dey respet, na-im send us kom. One angel kommand am sey make e invite yu kom prish gi-am.”


Na bikos of dis I dey always try my best to get klean belle for God and pipol front.


and make una try to live for peace with evribody.


Finally, my brodas and sistas, tins wey bi true; wey get respet; wey fine; wey pipol dey tok good about; wey good well-well; wey rish to praiz, na dis kind tins una suppose to dey tink about.


Make una dey do well, so dat una go live kwayet life; dey mind una own business and dey work with una hand as wi kommand una before.


Make una try to live for peace with evribody and dey holy, bikos anybody wey nor dey holy, nor go si God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ