14 And nor bi Adam, Satan deceive. Satan deceive di woman and na so sin take kom dis world.
Wen di woman si sey di fruit wey di tree dey produce fine well-well and e good to chop; and e go make pesin get sense well-well, e kon take some of di fruit chop. Di woman still give some to en husband wey dey with am and e kon chop too.
If e born girl, e go dey unklean for fourteen days as e bi wen e dey mestrate and e go stay for sixty-six days, before e go dey klean.
But I dey fear sey, just as di snake deceive Eve with en wayo, una mind fit spoil komot for di true and di way wey una dey follow Christ.