13 bikos na Adam God first kreate, nor bi Eve.
So God kon kreate human being like ensef; as God bi, na so E kreate dem; both man and woman, na-im E kreate.
Den God kon sey, “E nor good make only man dey. I go gi-am somebody wey go make belle sweet am.”
Den Oga God make anoda pesin from di rib wey E take from di man, den E bring am kom meet di man.
So Oga God take some san-san for groun take mold man kon breath life enter en nose, den di man kon dey breath.
God kon tell di woman, “Wen yu dey labor, I go make am pain yu well-well. Na inside pain yu go take born shidren. Yu go won kontrol yor husband, but na-im go bi yor head.”
Di man kon koll en wife Eve, bikos na en bi mama to evritin wey dey alive.