Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Timoti 2:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 First of all, I tell una make una dey pray, ask and tank God for evribody.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Timoti 2:1
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Una must give dem dis tins, so dat dem go fit offa sakrifice wey God wey dey heaven go asept and pray make E bless mi and my sons.


Make una praiz en name wey get glory forever! Make en glory dey di whole eart. Amen!


Make una work well-well for di town wey I send una go as prisonas and make una pray make I bless dem, bikos if dem prosper, una go prosper too.


God don forgive us for di time wen wi nor know wetin wi dey do, but naw, E dey kommand pipol for evriwhere sey make dem turn from sin kom meet am,


Today, I tank my God thru en pikin Jesus Christ for all of una, bikos na for di whole world dem dey tok about how una faith for God strong rish.


But wi tank God sey, even doh una bi slave to sin before, una don use una heart dey obey all di tins wey wi dey tish una.


Bikos na wetin I receive, naim bi di first important tin wey I give una; sey Christ die for awa sins as dem rite for God word


Na dis make us beg Titus sey, as e don start, e good make e finish dis good work wey e dey do, bikos e love una.


Na dis make mi tell una sey, make una nor fear bikos of di tins wey I dey sofa, bikos na for una own good.


With awa Oga God Jesus Christ name, make una dey tank God awa papa for each oda.


With difren prayers, make una dey ask God to help una. Make una always dey pray with di Spirit and dey shine una eyes well-well. Make una nor give up, but make una kontinue to pray for all God pipol.


Make una nor let anytin worry una for mind. Instead, for evry kondishon wey una dey face, make una ask God thru prayer for evritin wey una nid and make una always dey tank am, as una dey pray.


Make Christ make una love for each oda and for evribody, grow more-more and big, just as awa love for una bi,


Wi get betta rizin to dey tank God evritime for una, bikos una faith dey grow more-more and di love wey una get for each oda, dey grow too.


bikos E wont make evribody dey save and undastand di trut.


Naw, woman wey en husband don die and e really dey alone for dis world, dey trust God. E dey pray for nite and day sey make God help am.


Pesin wey bi Christ savant nor dey kworel, instead e must dey good with evribody; must sabi tish well-well and get patient with sturbon pipol.


Bikos God grace wey bring salvashon, don kom out make evribody si am.


Make dem nor ever tok bad about anybody, instead make dem dey live for peace, dey gentol and dey bihave well to evribody.


As una still dey dis world, wi wont make una kontinue to love one anoda, so dat wetin una dey hope for, go kom.


So make una konfess una sin to each oda. Make una pray for each oda, so dat God go heal una. Di prayer wey pesin wey good for God eye take all en mind pray, dey work well-well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ