Na from us dis pipol from komot, but dem nor really dey God family before, bikos if to sey dem dey, dem for stay with us. But dem live us, so dat evribody go know sey dem nor bi awa own.
Make yu remember wetin yu don hear and receive and make yu obey dem kon turn from sin kom meet God. If yu nor shine yor eye well, I go kom like tif and yu nor go know di time wen I go kom.
I know evritin wey yu dey do. (Si, I don open door for yu wey nobody go fit klose.) I know sey yu nor too get pawa, but yu don obey my word and yu nor deny mi at-all.