Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Timoti 1:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 e si mi as good pesin kon choose mi to serve am. But God sorry for mi, bikos den I nor know wetin I dey do and I nor bilive en gospel.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Timoti 1:13
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go make my pipol stay for di land and dem go prosper. Doz wey dem dey koll “No-pity” before, I go pity for dem and doz wey dem dey koll “Nor bi my pipol,” I go sey, “Naw, una don bi my pipol”, den dem go ansa sey, “Na Yu bi awa God.”


But wen di sore don heal and e don turn white back, di pesin go-go meet di priest,


“ ‘But anybody wey kommit sin with en mind, weda dem born am for Israel or na strenja, dat pesin don curse God and dem must kill-am,


“Di savant wey know wetin en oga wont and e nor do am, dem go flog am well-well.


(Den Jesus kon sey, “Papa, make yu forgive dem, bikos dem nor know wetin dem dey do.”) So, di sojas kon gambol to know who go take Jesus klot.


I sofa Christians and I dey kill pipol wey dey serve God, dey tie pipol trow for prison, weda dem bi man or woman


So my brodas, I know sey una and una oga dem nor know wetin una do.


But Saul try to distroy di church; e dey go from house to house dey arrest men and wimen put for prison.


As all dis tins dey happen, Saul still dey tell di disciples sey e go kill dem. E go meet di High Priest


But Ananias ansa, “Oga God, many pipol don tell mi about dis man and all di wiked tins wey e don do to yor pipol for Jerusalem.


So e ansa, “Oga God, na who dey tok so?” Di vois ansa am, “I bi Jesus Christ wey yu dey ponish!


bikos na mi small pass among all di apostles. But, I kause many wahala for God church, so dem nor suppose koll mi apostle.


Koncerning pipol wey neva marry before, I nor get any kommand from Christ to give una, but I go advise una as pesin wey una fit trust, bikos God dey show mi mesi.


Una don hear about di kind life wey I dey live before as Jew pesin; how I trobol di church kon dey try to distroy am.


Bikos I really won do God work, I kon dey kause sirious wahala for di pipol wey dey di church. I do evritin just as di law sey make wi do, so dat wi go dey good for God eye. So, I nor get any fault.


But God sorry for mi, so dat Christ go use mi as betta ezample to show sey, e dey patient with even di pesin wey sin pass. Den odas go know sey, demsef go fit bilive am kon get life wey nor dey end.


Make wi nor fear to enter where God throne dey: di place where grace dey, so dat wi go get mesi and God grace go help us wen wi nid help.


Before-before, una nor bi God pipol, but naw, una don bi en pipol. Dat time, God nor get mesi for una, but naw, una don get en mesi.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ