Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Tesalonians 5:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 But since wi bilong to lite, make wi dey kwayet, use faith and love take protet awa chest, den wear di hope wey wi get like priest kap for head.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Tesalonians 5:8
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wetin make mi nor get hope? Wetin make my heart nor dey happy at-all? But I go still put my hope for God hand! I go still dey praiz am, bikos na-im bi my Savior and God!


But wetin make mi nor get mind? Wetin make my heart nor happy at-all? I go put my hope for God hand! I go praiz am again, bikos na-im bi my Savior and my God!


Wetin make my soul dey weak? Wetin make my heart nor happy at-all? But I go put my hope for God hand! I go praiz am again, bikos na-im bi my Savior and God!


E go wear good judgement for body like war koat kon wear viktory like priest kap for en head. E go wear klot wey go make am do good tins kon ponish doz wey dey sofa pipol.


So e betta make wi sidan kwayet kon wait until God go kom save us.


And naw wi get faith, hope and love. But di one wey big pass for di three, na love.


thru di word wey wi dey tish with God pawa; with wetin wi take dey defend awa raitiousness both for awa rite and left hand;


Bikos na thru faith for God Spirit, naim wi hope sey, God go make us dey good for en eye.


Make una wear komplete soja uniform wey God dey give, so dat una go fit stand fight di wayo wey devil dey use.


I pray sey make God, awa Papa and Oga God Jesus Christ give all my fellow Christian brodas and sistas peace, love and faith.


bikos all of una na lite shidren. Wi nor bi nite or darkness shidren,


Naw I dey pray sey, God wey love and give us betta konfort thru en grace and hope,


Dis hope strong for awa heart like ship wey dem tie make e nor for move, bikos di hope wey wi get dey kamkpe and strong gidigba. Di promise go take us pass di curtain for heaven, until wi rish where God dey;


So, make una always dey ready for akshon. Make una shine una eye and put hope for di grace wey Jesus Christ go bring.


But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.


But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ