Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Tesalonians 5:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Bikos of di work wey dem dey do, make una love and respet dem well-well.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Tesalonians 5:13
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den e send en brodas go and dem kon komot from en present. E tell dem, “As una dey travel, make una nor let fear worry una.”


Make una si as e dey good and wonderful wen God pipol dey stay togeda for peace!


“Pesin wey welkom yu, welkom mi too and anybody wey welkom mi, welkom di Pesin wey send mi.


“Salt good, but if e nor get taste again, how pesin go fit take make am sweet? Make una get salt inside una and make una dey live for peace with each oda.”


Wetin I dey tell una bi sey, ‘Make una love each oda.’ ”


Finally my brodas and sistas, make una use happiness dey do tins as dem suppose bi. Make una take heart, dey greet each oda and live togeda for peace and di God wey get love and peace, go dey with una.


even doh my sickness na problem to una, una nor laf or drive mi. Instead, una welkom mi like God angel; like sey na mi bi Jesus Christ!


But di fruit wey di Holy Spirit dey bear inside us; na love, joy, peace, patient, kindness, goodness, faithfulnes,


Di pesin wey dem dey tish God word, must share di good tins wey e get with di pesin wey dey tish am.


Make una dey do evritin wey una fit do to keep di unity wey di Spirit dey give, as una dey live togeda for peace.


Make Christ peace dey rule una heart (bikos na thru dis peace, Christ take koll una as one body) and make una dey tank God.


Wi dey beg una, awa brodas and sistas, make una tell pipol wey dey bihave anyhow sey, wetin dem dey do nor good, den make una help doz wey dey weak, but make una dey patient with evribody.


Naw, make Christ wey dey give peace, give una en peace evritime and make di peace dey with una always.


Make yu run from doz tins wey dey hongry yong pipol to do, so dat yu go please God forever. Den yu go fit love and stay for peace with odas wey dey serve God with klean heart.


Make una try to live for peace with evribody and dey holy, bikos anybody wey nor dey holy, nor go si God.


Pipol wey nor like trobol, dey plant fruit wey dey bring raitiousness.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ