Bikos of yor love, Yu dey patient with dem for many years. Yu send yor Spirit wey warn dem thru di profets. But yet, dem nor gri listin! So Yu allow oda nashons attack dem again.
So Moses sey, “Wen God give una meat chop for evening and bread for morning, den una go know sey, E don hear all una komplain. Wetin wi bi sef? Una komplain nor bi against us, but na against God.”
God wey bi di Holy One and di Pesin wey save Israel; di Pesin wey wi dey sin against; wey dey serve rulers, dis na wetin E tok, “Kings go si yu kon stand, prince go bow down, bikos of God wey dey good wey bi di Holy One for Israel and naim choose yu.”
Na God wont make e sofa and en deat na sakrifice, so dat God go forgive pipol dia sins. So en days go long and e go si en shidren-shidren and thru am, God go do wetin E wont.
“ ‘Una wey dey laf; make una hear, una go sopraiz till una die! Bikos I go do sometin for una time, sometin wey una nor go bilive even if dem tell una.’ ”
Dem show sey nor bi demsef dem dey work for, but na for una, bikos una hear dis matter from di apostles thru di Holy Spirit pawa wey kom from heaven. Even angels dey wish sey dem know dis tins.
So anybody wey do all wetin God tok, dey inside am and God dey inside dat pesin too. Wi know sey E dey inside us, bikos di Spirit wey E give us, dey stay inside us.
But today, una don rijet di God wey save una from all una trobols and wahala. Una don sey, “No! Choose king wey go rule us.” Naw make una stand for God present akordin to una tribe and family.’ ”