Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Tesalonians 4:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Una wey bi man, make una dey live with una wife for holiness and with respet,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Tesalonians 4:4
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But God tell Ananias, “Make yu go meet am, bikos I don choose am make e karry my name to Gentile pipol, kings and all Israel pipol.


So God don leave wiked pipol make dem dey do di bad tins wey dia mind, wey bi sey man dey sleep with man and woman dey sleep with woman.


My brodas and sistas, God dey good. So Abeg, as una dey alive, make una dey offa una body gi-am as sakrifice. Make una dey do wetin E tok and wetin go make belle sweet am. Na dis bi di best way to serve God.


(I dey tok with human being sense, bikos I know sey una dey weak.) Before, una dey give una body like slave to bad tins, but naw, una must use una full body take serve God, so dat una go dey do only wetin God wont.


Una nor know sey una body na part for Christ body? So e dey good make wi put awa body for ashawo work? God forbid!


But make una nor for dey do ashawo, e betta make una marry.


But if dem nor fit kontrol demsef, make dem marry, bikos e betta make pesin marry, dan make e dey tink bad tin for en mind.


But dis betta tin wey God give us, wi dey karry am for inside awa body wey go die like klay pot wey break and na God give us di pawa.


Finally, my brodas and sistas, tins wey bi true; wey get respet; wey fine; wey pipol dey tok good about; wey good well-well; wey rish to praiz, na dis kind tins una suppose to dey tink about.


Make evribody respet marriage: una must make sure sey una nor sleep with who nor bi una husband or wife, bikos God go judge pipol wey dey sleep with who dem nor marry and pipol wey don marry, wey dey sleep with oda pipol.


Husbands, make una dey trit una wife with soft hand, bikos una know sey dem nor strong rish una; make una respet dem as pipol wey get God grace and life. If una dey do like dis, nor-tin go block una prayers.


David tell di priest, “True-true, dem nor dey sleep with wimen wen wi dey go war. Dia swods sef dey holy, even doh na ordinary journey wi dey go. So today, dem even dey holy well-well!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ