18 So make una dey enkourage each oda with all dis word.
Den I tell Seraya, “Wen yu rish Babilon, make sure sey yu read evritin wey I rite loud make evribody for hear yu.
So, wen dis tins dey happen, make una stand and dey ready, bikos una salvashon don near.”
God go karry wi wey remain for dis world go meet dem for sky, den all of us go-go meet Christ for heaven.
Brodas and sistas, koncerning di time and sizin wen dis tins go happen, wi nor nid to rite anytin give una.
So make una dey enkourage and help each oda, just as una dey do naw.
Wi dey beg una, awa brodas and sistas, make una tell pipol wey dey bihave anyhow sey, wetin dem dey do nor good, den make una help doz wey dey weak, but make una dey patient with evribody.
So una hands and knees wey don taya, make una make dem strong.