Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Tesalonians 4:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Bikos wetin wi dey tish una naw, na wetin Christ tish sey: Wi wey dey alive wen Jesus go kom, nor go follow am go kon leave doz wey don die bikos, all of us go-go with am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Tesalonians 4:15
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God tell one profet from Judah make e go Bethel and e rish der wen King Jeroboam stand for di altar dey do sakrifice.


but instead, yu kon go back go chop for where E sey make yu nor for chop. Bikos of wetin yu don do so, yu go die and dem nor go beri yu for yor family grave.”


God kommand mi sey, make I nor chop or drink anytin and make I nor go back di wey I take kom here.”


As God kommand, one profet among all di profets kon sey make dem beat am. But di oda profet nor gri,


But Profet Mikaya ansa, “I promise una with God wey dey alive sey, I go only tok wetin God sey make I tok!”


Who don give mi anytin kon sey make I pay back? Evritin wey dey under heaven na my own?


My God, I dey kry give Yu and I go kontinue to beg Yu evriday by day.


Pita ansa, “Yes.” As Pita enter di house, Jesus kon ask am, “Wetin yu tink, Simon? Who dey pay tax give kings for dis world? Na pipol for di kountry or strenjas?”


And doz wey bilive Christ before dem die, don lost bi dat.


E good to dey boast, even doh gain nor dey inside. I go still dey tok about di vishon and revelashon wey Jesus Christ show mi.


Wi do like dis, bikos wi know sey di Pesin wey raiz-up Jesus, go still raiz us up with Jesus and E go take wi and una enter en kingdom.


Bikos I nor get or learn am from anybody, but I get am thru di revelashon wey Christ give mi.


Nor bi una bi awa hope, joy and crown wey wi go take boast give Jesus wen E kom? Yes! Na una!


Awa brodas and sistas, wi wont make una know di trut about doz pipol wey don die, so dat una nor go dey sad like pipol wey nor get hope.


wey die for us, so dat weda wi dey alive or wi don die wen e kom, wi go stay togeda with am for heaven.


Naw my brodas and sistas, for di time wen Jesus go kom and wen God go gada us go meet am, wi won tell una sey,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ