Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Tesalonians 4:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Make una dey do well, so dat una go live kwayet life; dey mind una own business and dey work with una hand as wi kommand una before.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Tesalonians 4:11
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E betta to chop dry bread with peace of mind, dan to get plenty food for house with kworel.


To start kworel bi like wen yu leave wota make e dey rush; so e go good make yu stop am, before e go kause big wahala.


E betta make yu get small propaty with peace for mind, dan to dey work hard, bikos yu nor go still gain anytin and e bi like wen pesin dey try to katch breeze.


So e betta make wi sidan kwayet kon wait until God go kom save us.


E go bi like wen man dey travel go far. E leave en house make en savant look am, give dem work do kon tell di gateman make e wosh en house.


and bikos dem dey do di same work, e kon stay with dem dey follow dem work (na tent dem dey make sell).


Like dis, I don show una sey wi must help pipol wey dey weak and una remember wetin Jesus Christ tok, wen e sey, ‘E betta make pesin dey give pipol tins, dan make e dey kollect from dem.’ ”


Make una nor taya, but with di Holy Spirit help, make una serve God with betta mind.


But I like to prish di Good News for where pipol nor know Christ, so dat I nor go build house on-top anoda man foundashon,


Wi dey work hard before wi go fit chop and as pipol dey curse us, na blessing wi dey give dem back. Wen wi dey sofa, wi dey-dey patient.


So, weda wi dey alive or wi don die, wi dey do evritin wey wi fit do to make Christ happy.


Pesin wey dey tif, make e nor tif again. Instead, make e work hard and do good with en own hand, so dat e go fit give pipol wey nor get.


Make una pray for kings and doz wey dey rule, so dat wi go fit live for peace, get betta karata and good life with fear for God.


For di same time, dem go dey lazy, dey waka from house to house, dey do aproko and tok anyhow.


Like dis too, awa pipol go learn how to do good and help pipol wey really nid help. And as dem dey do like dis, dem nor go live yuzles life.


Instead make e show sey Christ dey inside una and una don get gentol and kwayet spirit wey God go value.


But make anybody among una nor sofa, bikos e kill, tif or curse trobol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ