As I dey lead dem kom back, dem go dey kry, beg and pray make I forgive dem. I go guide dem pass where wota dey kon take dem pass strait road where dem nor go kick stone fall. I go do am, bikos na mi bi Israel papa and Efraim na my first-born.’ ”
Oga God ask di priests, “Pikin dey honor en papa and savant dey respet en masta, but wetin make una nor dey honor mi wey bi una papa? If I bi una masta, why una nor dey respet mi? Una nor dey respet mi, yet una dey ask, ‘How wi nor take dey respet Yu?’
Make una look di birds wey dey fly for sky, dem nor dey plant or put anytin wey dem gada inside store, but una Papa for heaven dey feed dem. Una nor betta pass dem?
But wen una dey pray, make una go inside room, klose di door and pray to una Papa for sekret. And una Papa wey dey si for sekret, go reward una for pipol present.
Jesus ansa am, “Make yu neva tosh mi, bikos I neva go meet my Papa for heaven. Go meet my brodas, tell dem sey, ‘I dey go heaven go meet my Papa, wey bi yor Papa too; my God, wey bi yor God too.’ ”
God big angel go shaut dey kommand as Christ dey kom down from heaven; di angel vois go dey loud with God trumpet and doz wey bi Christian before dem die, go first go up.
Make una si di kind love wey awa God get for us. And naw, pipol dey koll us God shidren and true-true, na God shidren wi bi. Di world nor know us, bikos dem nor know am.
And I hear one loud vois from di throne dey sey: “Make yu look! God house don dey with human being naw. E go stay with dem and dem go bi en pipol. God ensef go dey with dem.