Kings go bi like una papa and kweens go bi like una mama. Pipol go bow dey honor una with respet. Den una go know sey na mi bi God, bikos I nor go disgrace anybody wey dey wait make I help am.”
Nor bi mi kreate or born dem o-o! Why Yu go tell mi sey make I kare and karry dem for my hand like sey dem bi small pikin? Na so I go take karry dem go rish di land wey Yu promise dia grand-grand papa?
Wen I dey with pipol wey get weak faith, I dey live as dem dey live, so dat I go fit win dem. I dey do evritin wey I fit do, so dat I go fit win evribody wey I fit win, kom meet Christ.
True-true, bikos e nor show en pawa, na dat make dem fit nail am for cross, but e dey alive naw, bikos of God pawa. Aldo wi dey weak with am, but wi go dey alive togeda with am, bikos of God pawa wey wi get.